You be the reason why goosebumps no dey fit comot for my skin.
E crest for my body and e no ready to comot anytime soon.
E no get anytime wey I no try hold my chill
Make I see whether the motion fit slow
The matter wey dey ground don pass play-play something.
I no fit mention the impact wey your love don create for my body.
E sure me sey this happiness wey I dey get from your love na genuine one.
I don try check myself plenty times
Make I see whether na clear eyes I take dey see this one
Or whether na konji
I see sey the love cover my eyes well well
Me sef no go like make e clear anytime soon.
The stamina wey I dey get when I dey around you
No be wetin to mention.
E be like the water wey dey inside coconut.
I fit drill in and out of any hole without remorse or recourse.
I dey do wetin mouth no fit mention.
No mind those fellas wey dey tell you sey I no good for you.
Them no sabi wetin I dey feel for you.
Them get their own interest
Na wetin dey pain them be that.
Them say I too bad for you.
No mind them; them dey lie to you.
So many girls fine pass you
None fine pass you where I dey
Your beauty don captivate my heart
I no fit understand again.
See my heart; take am
Na your own be that.
Do am as you like
Abeg make you no break am.
Handle am with care
Soak am deep down the fragrance of your beauty
Deep into the abyss
Whether na beach e be
Me sef no go mind comot cloth enter.
You no go lie
I know sey you sef know sey you dey feel me too.
I dey give you reasons to speak
To understand in different languages
Languages wey people no fit understand.
No waste time come
I know sey na you I go like spend the rest of my life with.
I no fit wait walk down the isle with you
The heat wey from you don set my soul on fire.
Come fast, come make my life feel brand new.
Poem by Stephen Olukanne Ngofa